"Vacancy" by Offor Patience
I dey fin persin,
I dey fin persin wey go tell dose pipu for up say,
Dreams are dying
Visions are becoming blur
Destinies are being delayed-
They are folding up!
I dey fin persin wey go tell dem say e no good o!
When dia chudren dey private schools,
Some dey outside Hood,
We, we dey here dey suffer!
Course of 4years go take 6years,
Na so so strike everywhere.
I dey fin persin wey go tell dem say we don tire
We don tire to stay house
We don tire to do runs
We don tire to dey handle pistle
We don tire to dey waka for road with certificates
We don tire to dey epp dem pound new born babies make dem for get political powers
WE DON TIRE!
I dey fin persin wey go tell dem say dem don too old to rule
Make dem hand over power give us wey our blood still dey hot.
I dey fin persin wey go apply for this VACANCY
#Ifnayoumakeyouapplyfast#
Comments
Post a Comment